03/11/2026
HOW YOU GO KNOW SAY NA SPRAIN? 7 SIGNS! 🦶
My Benin people, many of una dey confuse — "Aunty Nurse, na sprain abi na bone break?"
Make I break am for una for Pidgin:
7 SIGNS SAY YOUR LEG DON SPRAIN:
1. PAIN GO START THAT SAME TIME - GBIM!
E no dey wait. As you twist leg for gutter, pain go catch you immediately!
2. LEG GO SWELL LIKE BREAD
Within 10 minutes, leg go swell. If you press am with finger, your finger go sink enter.
3. LEG GO TURN BLUE/BLACK
After some hours, leg go black or blue. No fear, na small blood from inside.
4. YOU NO FIT WAKA AGAIN
You go dey waka like old man — "kirim kirim". If na hand, you no fit carry bucket of water again.
5. THE PLACE GO HOT
If you touch am, e go hot pass the other leg.
6. LEG GO STIFF
Your leg go stiff because of bad road😭
You no fit bend am. For morning, e go hard well well.
7. YOU FIT HEAR KPOYIM SOUND
Some people dey hear "kpor" when leg twist. That one na serious one!
SMALL SPRAIN vs BIG SPRAIN:
Small One:
- Small swell, you fit waka small small
- After 3 days, pain don reduce
- You fit treat for house
Big One - RUN GO HOSPITAL:
- Leg big like pillow
- You NO FIT stand at all, even small
- Leg black well well
- Pain no reduce after 2 days
- Leg dey shake like e want comot
My people, if na big one, no sit down for house! Come my shop for Benin make I check, or run go Central Hospital go do X-ray.
Una don see any of these signs before? Which one be your own? Talk for comment! 👇
Abeg share for your padi wey leg dey always twist for football field! ⚽
From una Nurse Evelyn, chemist shop nurse for Benin. Na for teaching I talk am o, no be hospital prescription. If leg big well well, go hospital quick quick!